Na Gbola Dey Save Me For This Lagos - Episode Two

 


By the time wey I finish with Mama Uka, body tell am say na fresh blood handle am. I carry the 10kpa wey she give me for mind, take give am all those mojó styles wey I dey watch for Ekene house. E no easy for me o, but I rugged am. E get when e reach sef, e kon be like say her kpomo wan swallow me. I thin well, well, and she too big, that place spread like 3 people own. I never see that type before, all the girls wey I dey gbensh for area no get that size, their own still dey tight, e dey even pain me sometimes, no be all of them dey carry water. Mama Uka own cream eeh, na my size, everything fit, water dey rush. Oya, make I no lie sha, the thing sweet me different. 


She no change am for me say I dey wunjure her or make I allow her rest small. She just dey shout, still dey collect the thing like person wey never chop since. When I finally reach the ending, my shoulders kon rise, like one big boy wey win lottery, she no quick stand up, everywhere don weak. Na so she look me, with large smile for her face …


Matthew; wetin be this o? I never belleful like this before. I no believe say I dey see you everyday, I no know say you carry wetin go save my life, day waka up and down. This boy don finish me this night sha, ogunu? Abeg, pass me my bag, make I top up for you, 10kpa too small for wetin you do for me so”

I carry her bag give am, she kon count another 10kpa, say make I take join the first one wey she give me. Omo, I wan happy kpai. Just like that, say I do one knackis, naim 20kpa dey my hand so. I clean my eyes look the money again, body just dey sweet me. I don quick calculate wetin I go use the money buy. I go enter aswani markey go charter boxers, polo and some jeans. I go even buy singlet join, e don tey wey e dey hungry me, but I no get the money. Mama Uka see as I dey happy because of the money, she kon say …


Mama Uka; see eeh, this one na small thing, compared to wetin I go still do for you. Just dey treat me like this, I go make sure say you no go lack anything. Make I see the phone wey you dey use”

I bring out my kpalasa phone, show am”

Mama Uka; this one don kpai na, fine boy like you no suppose dey use this kain thing. No worry, make tomorrow reach, I go buy you new phone. Come back here by same time, I go give am to you, that one na small thing, you hear?”

Na so I kneel down ozugbo …


Matthew; haaa! God bless you, ma. I never use new phone for my life before. This na my first phone for this life and 3 people don already use am finish, before I buy am. God o, na which hand I wan take hold new phone? Ma, God go bless you, thank you, ma”

Mama Uka; na this ma wey you dey call me now, go vex me. You no go handle me finish like this still dey do ma up and down, dey call me darling. If I give you the phone tomorrow, you go use darling save my number, I go dey call you baby. Oya, talk am now, make I hear as e be for your mouth”


Matthew; darling. Na my darling you be. Na you get me like this, anything you want for this life naim I go do for you”

Mama Uka; na now you come. You no see as e sweet for mouth? Infact, e get one party wey I want make you follow me go tomorrow, make I use you show off. All those women wey dey carry their baby come, dey buga for me, make I dey kpai dey swallow saliva anyhow, I go show them say my own baby don arrive and you set pass their own. Shebi you get better cloth and shoes wey you go wear? I no want make you dress like boi boi follow me”

Matthew; chai, I no get o. You sef dey see wetin I dey wear come work, I no get any better cloth or shoes wey I fit wear go party, na why I no dey go that kain thing”

Mama Uka; that one no be issue. By 11 o clock tomorrow morning, make you come meet me for shop, I go carry you enter that boutique wey dey busstop, make you select few things, dem dey sell shoes sef for there” …


By the time we finish all the arrangements, e don reach 11 o clock for night, she say make I first comot for the hotel, say she go leave later. Dem no born me well make I trek again, with the kain plenty money wey dey my pocket. Na muscle I take halla okada to carry me go house. Pepper dey rest wella for my pocket, na to go open account remain. I no go dey keep money for house again. 

I just dey reason say I carry wetin suppose make me big boy since, naim I dey suffer anyhow, dey waste am for all those girls for hood, wey no dey gimme anything, instead, na me dey drop 2h or 5h, sometimes, just to collect. No be say e no dey sweet them o, choi. Like this, I don hammer. 

My mama wan change am for me as I enter house, because na almost 12 midnight. Na so I carry 5kpa flash am for face, she shock. Small fear been wan catch am, whether I don dey follow bad people, I tell am to chilax, say na big work I do for Mama Uka and she pay me wella, say she fit go ask am. Na so my maale begin dance o, kon hug me. I tell am to cool down, say I don get better work now, I go dey find am something, small, small. 


The next day, Mama Uka carry me enter the boutique, fear no gree me touch anything, as I see the amount for the label. I never enter that kain place before, say I dey find wetin? When she see say I no get liver to pick anything, she kon begin pick for me. She pick 4 jeans and 6 tops with 3 sneakers, say make I go taste them. If una see how the clothes take me eeh, e be like say na me dem see take make the jeans and tops, abi na the sneakers? Big boy no pass like this o. 


When we finish, she say make I follow am go shop to collect the phone, the person don bring am come. We reach her shop, one man carry small nylon give am, she collect am, pass am to me, say make I open am. I wan run mád. Na one big techno phone dey inside, my hand just dey shake as I dey turn the carton round, be me like film trick, like say she go still collect the phone from me. She say make I go house go keep clothes wey she buy for me, and come back, make we go the party. 

She still give me 2kpa, make I use fly bike. Na so I rush dey go house, she even tell me the clothes wey I go wear, if I dey come back, and shoes wey match am. 


When I reach house, wear the clothes, keep the rest, kon charge the new phone small, arrange my sim inside, I rush begin go back to Mama Uka shop. As I reach, she say make I go that hotel go wait for am, say she wan collect one round take hold body, before we enter the party. 


Wetin I do am for the hotel eeh, e pass the first one wey I do am. I no even remember say I go carry her enter shower or worry about all the sweat wey full the kpomo, I chop everything without brake. I use mouth, hand, gbola, e remain small sef, make I use leg. Mama Uka just be me like one angel wey come to change my life, na my gbola dey pay for am, and e worth am. Big gbola wey sabi work na better money o. God carry better blessing put for my body, I no know, naim I just dey suffer since. Mama Uka say I be guru, small body, big machine. 

If una see as I balance for Mama Uka jeep, with can beer wey she give me, as she dey drive dey go the party. First time for my life wey I enter that kain car, ac dey wipe me for body, I sidon like fowl wey rain touch. 


The party no be small pikin party. Rich women wey get better raba. Their body be like glass, just be like na from obodo oyibo all of them from come, all of them wear gold, with clothes wey dey shine enter eyes. See as them dey spray money like say na water. People just dey match money dey waka. 

Na for that party my life change gan gan. The things wey Mama Uka dey do for me na something hooge, but wetin my eyes see next, Mama Uka dey learn for that side …

****************

Where my mama dey when God dey create dis rich women? This money and this kain life go fit my mama kpai, that woman don too suffer for this life. Mama Uka carry handbag give me to hold for her, as she begin waka around to greet people. I no even know wetin dem dey celebrate or who dey do party, na cash wey people dey match for ground my mind dey. If dem no need dis money, make dem comot for road na, make I go pick am, which kain thing be this? I dey see money but I no fit touch am. Person tap me small for shoulder say food don arrive, I tell am thank you, but my mind no dey for the food jare, na the money wey dey ground I dey reason.

 

Small time, Mama Uka come back with one woman like that, say make I help the woman carry something go her boot for car. I greet the woman, collect wetin she carry, dey waka go front, as she follow me for back. Mama Uka no follow us, she sidon dey wait for me. I turn look the woman from head reach legs. She use scarf cover her head, she no wear all the gold wey others wear and her cloth cover her body wella. She be like better born again, smile no dey her face. I say make I do fast begin go back to Mama Uka, before dis one go begin preach to me. 

When we reach her car, shock carry me. This woman dey drive Range Rover. I put the things for her boot, she kon smile for the first time, kon tell me thank you. The next thing na to ask me for my name …

The woman; you don try for me. Wait, make I find you small thing to take hold body. Wetin be your name?”


Matthew; my name na Matthew, ma”

The woman; I hope Mama Uka dey treat you well sha? You na very fine boy, you deserve person wey go show you better love. Wey go change your life totally. Na which car you dey drive?”

Matthew; car keh? I no get car o. Okada sef, I no get. Mama Uka dey try for me, God use am change my life, this cloth wey I wear sef, plus this phone, na she arrange them give me”…

I bring out my phone from my pocket show her. She tell me to open am, I open am. Na so this woman wey I think say na born again, carry my phone put her number inside, kon flash herself, then give me the phone back…


The woman; this thing no be phone, my gateman no even fit use am. Mama Uka tell me how sweet you dey to her, how you be her new catch. Upon everything wey she talk about you, na ordinary techno phone she carry give you. Iphone don finish for market ni? You see that thing wey I dey talk? Anyways, dey go meet am for inside, I go call you later make we talk. I get better deal for you wey pass her own, if you go take am, you let me know when we talk later. Oya, dey go, make she no find you come outside. No tell am wetin I talk o, no use your hand spoil better opportunity”…

As she talk finish, she bring out big money give me. The money too big, no be wetin I fit count for public. I rush put am for pocket, tell am thank you, kon dey go inside. As I dey waka, my chest just dey sound gbim gbim, very fast. I no understand wetin dey happen. Before I reach the entrance, I see Mama Uka for there, she dey look for me...

Mama Uka; where you go na? Just to help person carry something reach boot, you disappear”

Matthew; no o, she stop dey greet people, na why I delay, no vex”


Mama Uka; no problem. Na my best friend be that woman, she dey use her own sugar boy do shakara for me last year, na why I tell am about you, make me sef do small shakara, e no easy. You dey hungry?”

Matthew; I dey okay, my belle still full for food wey I eat for morning”…

Why I go hungry kwanu? Me, Matthew Ekwunife carry money wey dem use bank paper wrap, inside my pocket, naim I go dey think of food? 


We stay for another 30 minutes for the party. So many women just dey greet Mama Uka, all of dem dey look me like say Mama Uka don win lottery. Some of dem even touch me for face as I greet dem, Mama Uka go use laugh tell dem to comot hand o, say na she get me. Na den I kon understand wetin dey happen. All of dem dey runs small boys like me, even the ones wey wear wedding rings, to show say dem don marry.


By the time I reach house after everything, I count the money wey the woman give me, na 50kpa straight, house rent for one year. Na so I rush go where my mama dey fry akara for street…


Matthew; maale, how far na?”

My mama; haaa! Abobo, see as you fine. Chai, na money be find bobo o. The way you dress no even make me recognize you from far, until you reach here. See shoe na, my pikin fine. Where you see money buy all dis things?”


Matthew; person wey dey work, shey dem no dey pay am? I no understand this question o. You know since wey I don dey save? Maale, no dey whine me jor. How far our rent, you don pay?”

My mama; pay keh? Na that 5kpa wey you dash me make am reach 30kpa, I still dey find 20kpa like this. Landlord wan use insult finish me. This money wey I no get eeh. If say una papa dey alive now, shebi I…”


Matthew; e don do o, you go soon start now. I no want make you cry for me, I get rent money complete, but your wahala too much, you go dey worry me say where I take see money, upon say you know say I dey work since I dey 17 years, and I no dey follow bad people waka”

My mama; no vex for me, abeg. Na mama I be, I suppose dey ask to know where my children dey see money and wetin dem dey do? Make dem no put hand for wetin no good, just because we dey poor”

Matthew; take this money, make you pay rent, na 50kpa dey inside. I don tell you say I go change your life, you never believe am. The kain thing wey Mama Uka dey do for me now eeh, our poverty be like e go soon end”…


My mama wan faint, she just fall for ground, hold me for legs, dey cry as she dey thank me. Me just hold am, quickly collect the money back put am for pocket, as people don dey gather, make dem no ròb us. As we dey do the drama, naim my phone begin ring, I kon beg my mama make she behave na, say I wan answer my call, she kon stand up, carry better hug plaster for my body. She tell me to help her go hide the mula for house. 

The first call don ring finish, end. The second one start as I don dey road, I pick am…

Caller; Matthew, how you dey?”

Matthew; I dey fine. Abeg, na who dey talk?”


Caller; na Mama Uka friend, the woman wey collect your number for party today”

Matthew; Oh, okay. Good evening, ma”

Caller; I no wan talk too much, make I no waste our time. The thing be say, I like you, I wan keep you to myself, make you leave Mama Uka. I go tripple anything wey she dey give you”

Matthew; ma, I no know how I wan take do that one o. Mama Uka don show me better love, she buy me new clothes and new phone, things wey I no get before”

Caller; leave that one, jare. Which one be clothes and phone? Those ones no be anything na. Wetin go happen be say, I go give you my own deal, if you no want am, I no go call you again, you hear?”

Matthew; okay, ma”


Caller; the deal be say, I go put you for better house for lekki, I get bungalow wey I just build finish, well furnished, 4 bedrooms and parlor, I go also give you one Toyota spider wey I park for there, make you dey use. My baby no go dey trek, God forbid. By the time you don agree, we go discuss how much I go dey put for your account, every month, for upkeep. I go also do international passport for you, so that you go dey follow me travel, whenever I want. You no need to say anything for now, make you think am. I go call you by tomorrow morning, to get your answer. If you agree, I go carry you go show you the house for lekki, I go from there check wetin Mama Uka tell me about your sweet gbola, whether na true she dey talk or na lie. You hear me so?”…


My head dey ring, I no understand anything wey the woman talk, shey na dream I dey dream abi this woman dey whine me? Wait o, all dis things na because of gbola wey God take bless me, na like this my life wan take change? Mama Uka dey learn o, where dis one dey. I think say my life don better, I no know say na God just wan use Mama Uka show me my destiny helper. I talk am say I too fine to dey poor, I no suppose suffer for this life. 21 years boy like me, go dey drive motor, dey live for big house. Omo, na to go learn how to drive remain…

Caller; hello. Hello. Matthew, you still dey there?”


Matthew; yes, yes, I dey here. I don hear wetin you talk, I go use this night think am well. If you call me tomorrow morning, I go get answer down for you”

I already know wetin my answer go be, I just wan form like say I no desperate



Post a Comment

Previous Post Next Post